BREAKING: What Next For Nnamdi Kanu As Justice Binta Nyako Wash Hand Comot Im Case

E tok dis one inside court afta im lawyer Aloy Ejimakor try to convince di court say trial cannot start wen di Department of State Services (DSS) neva obey di court order to give dem a conducive environmnet to prepare dia case.....KINDLY READ THE FULL STORY HERE▶

Kanu, di leader of di secessionist group Indigenous People of Biafra (Ipob), dey face treason and terrorism charges wey di Nigeria goment sama am sake of im fight for di independence of di eastern region of di kontri.

E bin don plead not guilty to di charges.

As proceedings start on Tuesday, lawyer to di federal goment, Adegboyega Awomolo (SAN) tell di court say dem dey ready wit dia first witness, and dem dey request for witness protection.

But Ejimakor tell di court say dem still neva get opportunity to prepare dia client as DSS still dey gree give dem chance as court bin don order. E also tok say dem don file three appeals on di matter bifor di Court of Appeal, two of dem dey challenge di jurisdiction of di court and one dey challenge di revocation of Kanu bail.

Justice Nyako den suggest make Ejimakor allow for di prosecution counsel to call dia witness, and im and Kanu go get briefing for di court dia and come back di next day for cross examination.

Ejimakor insist dat e no go allow im client to enter trial witout preparation.

As di argument between Ejimakor, Awomolo and Justice Nyako dey go on, Nnamdi Kanu ask for permission to address di court and e tok say im no longer get confidence say Justice Nyako go deliver Justice for di matter.

“My Lord, you don consistently ignore di ruling of di Supreme Court wey tok say I no jump bail. And I also get three appeals bifor di Appeal Court for dis matter,” e tok.

Kanu den ask Justice Nyako to comot herself from di matter.

Prosecution counsel, Awomolo, oppose di application for di Judge to recuse hersef from di matter, but Justice Nyako tok say she no get any wahala to comot hersef from di case.

“I actually dey happy to recuse mysef from dis case and dat na wetin I go do. I go forward di case file to di Chief Judge of di Federal High Court for further action,” she tok, and rise.

Now wey Justice Nyako don comot hand for di matter, wetin go happen be say di Chief Judge go assign di case file to anoda Judge and di matter go start afresh.

But how long e go take neva dey clear. Justice Nyako bin tok for court say she go transfer di case to di Chief Judge of di Federal High Court, and she say di chief judge no dey around, but by di time e go get time to look di case, e go be around December.

She say e go take at least six months for di case to start again.

One lawyer wey follow BBC Pidgin tok wey no want her name mentioned also explain di procedure.

“Di chief judge go first see di file, e go study di case and make sure say evidence of bias no dey by di trial judge, den e go reassign di case give anoda judge. But if e study di case and no see any evidence of bias, e go return am give di judge wey dey on di case to continue wit di trial,” she tok.

Di lawyer add say di mata go drag for long as plenty cases dey bifor judges and di system dey choked.

Justice Nyako bin tok for court say she get ova 700 cases wey she dey work on and if one comot, na big relief for her.

Now dat Justice Nyako don comot hand for di matter, wetin go happen be say di Chief Judge go assign di case file to anoda Judge and di matter go start afresh.

E neva clear yet wen dis matter go start again, but e also mean say Nnamdi Kanu go remain in DSS custody until dat time.

Wen tori pipo ask am afta di trial weda im no dey worried say im go remain for custody for long, Kanu tok say “dis na di fourth year wey I dey stay for solitary confinement, di fifth year no go kill me”.

I dey against how dem dey pick some parts of di Supreme court judgement. I dey innocent, dem no get anytin against me, dem no fit hold trial wen dem dey violate key sections of di constitution and key Supreme court judgement”.

Lawyer to Kanu Aloy Ejimakor tell tori pipo say wetin make Kanu make di decision of ask di judge to comot her hand for di case be sake of say dem get three appeals wey court no handle well.

Supreme court criticise di revocation of im bail by di high court, di oda one be di issue of jurisdiction of di high court to oversee di case.

“We try to make di court understand our matter but di court no consider am, di court dey insist on di matter and wan do trial without giving im di opportunity to fair hearing, na im make our client make up im mind to tell di judge to comot her hand.” E tok.

Kanu don dey for di custody of di Department of State Services (DSS) since June 2021 wen security pipo gbab am for Kenya carry am come back Nigeria.

For di last court date on June 19, Kanu lawyer, Aloy Ejimakor bin tell di court say dem fit explore oda options outside di courts to secure im release.

Di lawyer say di discussion dey go on, e add say na di south east leaders and gi goment dey do di tok tok say e no be di work of di lawyers.

Ejimakor bin invoke section 17 of di Federal High Court Act, and section 174 of di 1999 constitution as e tok say parties in court fit explore alternative options for both civil and criminal matters.

Wen tori pipo ask am about dat option of out-of-court settlement, Ejimakor say “dat one no too dey for our hand, e dey for di hands of di leaders of di south east region. But I hear say di process don start”.